Monday, 25 January 2016

FRESH GBEDU: "BOLALE" BY OLUWA ICEE (PROD. Killertunes,Mixed by A.J)

Fresh jam from Spaceland Entertainment don drop o,na Oluwa Icee with im comfirm gbedu tune wey him title “BOLALE”,two months after im realease im impressive collaboration with Blinxzoe-Dancing Machine,wey people gbadu wella
Oluwa Icee don return with another ogbonge follow up Single wey im Title “BOLALE”…Produced by Killertunes and mixed by A.J,e go surely make you dey press replay button over and over again..
Instagram: @Icy534
Twitter: @oluwa_icee…

Sunday, 24 January 2016

Davido and Rumoured Guinean Babe inside one Party for NY together


E be like say Davido and dat him guinean babe, Sira still dey run tins o…  The singer and the 20 year old sharp barnie ( wey wear black) been slow down wetin dem dey call PDA for english for social media after dem born davido pikin(daughter) last year. Dem see the babe with her sister and her friend for Davido Sony Music Global record party inside Lagos Lounge for New York..  Check out more of their fotos



Huh? Lol...(photos)



Nawa oo…Abeg make una tell me wetin be dis this ...lol…..Make una see dis transgender woman, Her name na Fulvia Pellegrino, 56, from Italo (Italy) wey go spend $75k make she get sharp female body.  But dis one na confam  FAILURE..

MISS NEW HAVEN NIGERIA/AWARDS 2016.


BornBlaq Entertainment don join hand with JenStan Records come presents MISS NEW HAVEN NIGERIA/AWARDS 2016.
How You go take to register be say you go pay the Sum of #5000 to any UBA bank to the acct name: jenstan int'l ltd acct number :: 1002300529 UBA bank, mobile transfer is dey allowed but make sure say you screen munch the transfer receipt, carry your teller come the audition ground.
Grand prizes * Official Motor * #100.000 * international modeling Contracts 1st runner up * #200.000 *movie role * Wardrobe allowance. 2nd runner up *#100.000 *movie role *wardrobe allowance AMBASSADORS *Monthly allowance for 3months * Follow for Music Video * Become Face of a brand wey dey known OTHER boku consolation prizes still dey o......
AUDITION DATES *Enugu-30th Jan *Anambra -5th Feb *owerri -7th Feb *port harcourt-12th Feb *Abia-14th Feb *Lagos-20th Feb Make una Email ur phone number,name,picture ,location. To henrypeterz818@gmail.com.. For more tori call. 08137750818, 09091373081

Friday, 15 January 2016

LOL...Wetin dey happen here.

I don dey look this picture for long now,before I come realise wetin e really be, lol. This picture don spread like fire since immediately dem post am online. Some people say e resemble hairy nyash hole others say e resemble nyash with the top of im ear wey come be like nyash hole...but na just papa wey bend im head down dey kiss im pikin with im shoulder beside the pikin.

Thursday, 14 January 2016

How you go take know say you and your partner fit each other.

image
E get any particular thing wey go make relationship last? We know say some couples dey stay reach months or years before things go scatter. Others dey stay until death separate dem for marraige. How you go fit know say you and you nwa baby or nwa bobo suppose dey together? 
1. No pretending: Una two go dey real with each other. No mago-mago inside.
2. Una two go fit talk wetin una fit dey think. You know when you go support your Nwa baby or nwa bobo even before im ask sef.
3. Una two dey respect una two space wella. Una understand say time dey for everything,including "me time".
4. E dey do you for body like say something loss everytime una two no dey together.
5. Una no dey fear to discuss mata wey dey worry una for mind. Una dey talk una mind when something no dey ok,and una sabi how to talk so that e no go be like say partiality dey am..
6. Una still dey play like say una just dey meet.
7. Una no get problem with each other friends true true. You no mind make your partner hang out with im friends while you hang out with your own.

Khloe K don show stand out Nipples for New York o! (PHOTOS)


Khloe K been dey for new York for one kind show inside good morning America, she con ball out from one hotel wey dem call trump international hotel and tower with dis shaarrp making sense green dress. But hours before dat time, she been yan for twitter say her New York-bound go take one kind emergency landing inside Las vegas. Check out the sharp photos dem.