Thursday, 14 January 2016

How you go take know say you and your partner fit each other.

image
E get any particular thing wey go make relationship last? We know say some couples dey stay reach months or years before things go scatter. Others dey stay until death separate dem for marraige. How you go fit know say you and you nwa baby or nwa bobo suppose dey together? 
1. No pretending: Una two go dey real with each other. No mago-mago inside.
2. Una two go fit talk wetin una fit dey think. You know when you go support your Nwa baby or nwa bobo even before im ask sef.
3. Una two dey respect una two space wella. Una understand say time dey for everything,including "me time".
4. E dey do you for body like say something loss everytime una two no dey together.
5. Una no dey fear to discuss mata wey dey worry una for mind. Una dey talk una mind when something no dey ok,and una sabi how to talk so that e no go be like say partiality dey am..
6. Una still dey play like say una just dey meet.
7. Una no get problem with each other friends true true. You no mind make your partner hang out with im friends while you hang out with your own.

No comments:

Post a Comment